5 things wey we learn for Naija and Japan match
The kain koboko wey Dream Team boys take bilala Japan for Rio sweet all Naija fans for belle and naso people kon dey yarn say Naija go win gold for dis competition if dem carry on like dis.
Make unna read the 5 things wey helep Naija
1. Mikel dey waka go front well well: John Obi Mikel wey na him be the skippo for the Naija team carry swagga full ground for the match as hin bin dey waka go front dey helep Etebo.
Mikel at the dressing room before the game against Japan
Walahi na for the way wey Mikel Obi bin dey take operate for the midfield na hin kon make Sadiq Umar dey torment all the defenders wey Japan carry put for back.
2. Naija dey pass well: The way wey Naija dey take pass ball for the midfield juss dey sweet everybody wey watch the match for belle as Japan no gree understand the level wey Naija dey.
The true be say Naija bin no first get diasef well well when the match start, but na later na hin Naija boys kon take padlock lock Japan for inside box.
3. Naija boy get power: The thing wey helep Naija boys pass for this match na hin be de power wey dem get as dem show Japan say dem no be ajebutter.
Although Japan players sabi run like cheetah, but na the power plus skills wey Naija boys get na hin helep dem waya dem koboko.
4. Naija defenders bin dey sleep: For the match, unna go see say Naija attackers bin dey vex as dem dey enter Japan defence anyhow, but the defenders dem wey dey for back juss dey sleep and na hin make Japan carry 4 goals put for Naija net.
Naija defenders cause plenty kasala for back as na the yeye pass wey dem bin dey carry give demselfs na hin make Japan score dem.
5. Naija get swagga: The kind swagg wey Naija show for this match no be small thing as unna kon remember how Mikel Obi take carry de penarity wey Naija get give Etebo say make the guy play am.
If unna also see the touch line, unna go see say all the Naija players be padi as all of dem bin tanda gidigba for the back of the players wey dey inside field.
The post 5 things wey we learn for Naija and Japan match appeared first on Nigeria News today & Breaking news | Read Naij.com 24/7.